Kidnapped prospective corps members regain freedom
Wia dis foto come from,Getty Images
Published
14 minutes wey don pass
Read am in 1 mins
Prospective members of di National Youth Service Corps (NYSC) wey suspected gunmen kidnap as dem dey travel from Ibadan for southwest Nigeria go dia orientation camps for di South-East don regain dia freedom, according to di palace of di Olubadan of Ibadanland, Im Royal Highness, Rashidi Ladoja.
Di Olubadan media aide, Adeola Oloko said for one statement on Wednesday, 7 October, tok say Imo State govnor, Hope Uzodinma confam di release during one telephone conversation wit di monarch at about 5pm.
"Di Imo State govnor, Senator Hope Uzodinma confam dis for inside one telephone conversation wit di Olubadan of Ibadanland, His Imperial Majesty,Oba Rashidi Ladoja at 5.00pm today, Wednesday," di post tok.
Dis development dey come as a as relief to di families of di young graduates wey jaguda pipo kidnap last week.
Channels News report say di corps members currently dey receive medical attention for di Department of State Services (DSS) Hospital for Owerri.
Director-General of di National Youth Service Corps Brigadier General Olakunle Oluseye Nafiu dey for di DSS Clinic for Owerri dey address di rescued victims.
We still dey update dis tori!