Two icons, one retire wit grace, how im longtime rival fit hang boot?
Wia dis foto come from,Getty Images
- Author,Jess Anderson
- Role,BBC Sport journalist
- Published11 minutes wey don pass
- Read am in 6 mins
For one night wey one football legend receive big farewell from im kontri, anoda football legend wey dey about 6,000 miles away release one long statement explaining all di ways wey im national team coach wrong am.
Argentina legend Lionel Messi enjoy di love and praise from fans for Buenos Aires as im brilliantinternational career endwit one goal against Benin for one emotional night.
Meanwhile, Portugal star Cristiano Ronaldorelease one statementfor social media, wia e abuse im manager Jorge Jesus of "absolute breach of trust" while e admit say make dem hold am responsible for im own actions too.
Di former Manchester United and Real Madrid forward leave Portugal Nations League camp last week afta e remain unused substitute against Norway and later find out say e no go start against Denmark.
Portuguese journalist Jose Delgado tok say "tin go neva be di same again" for Ronaldo and Portugal, so na di beginning of di end be dis?
Jesus don tok say di door still open for Ronaldo to return to di national team, but e really open? Or dis matter go kontinu and possibly close di chapter on di international career of one of di greatest players of all time?
BBC Sport look at wetin fit be di end of di international careers of two football greats.
Skip content and continue reading- Click here to join BBC Pidgin Whatsapp Channel
- Subsidy don return? Wetin govment tok, how Nigerians react and all you suppose know9th October 2026
- South-African human rights lawyer Navi Pillay win 2026 Nobel peace prize8 hours wey don pass
End of content
Wetin dey happun wit Ronaldo?
Di Ronaldo matter don dey drag for some time, wit many fans criticising former Portugal coach Roberto Martinez for insisting on starting Ronaldo during dis summer World Cup.
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue readingDi one wey oda users dey read well well- South Africa pause applications from asylum seekers wey be undocumented migrants afta violent protests
- Who be US former Army major wey dem plan to livestream im firing squad execution
- Tiwa Savage and oda celebs wey face blackmail over sex tape
- Inec release full list of Presidential candidates for Nigeria 2027 election
End of Di one wey oda users dey read well well
At 41 years old, Ronaldo no be di energetic player wey e be bifor and many pipo tok say im presence dey affect di team more dan e dey help am.
However, tins finally reach one boiling point on Sunday when Ronaldo remain unused substitute for di Nations League victory against Norway. Di player later leave camp afta e discover say e no go start against Denmark for November.
On Tuesday, Ronaldo release one statement wey almost 2,000 words for Instagram wia e tok say Jesus don "break im promise" twice and accuse am of "complete betrayal of trust" bicos first e tell am say e go play against Norway but no play am, bifor e later change one agreed version of events wey dem suppose present to di media.
Ronaldo apologise to fans and teammates for leaving camp and tok say di consequences of dat action gatz be "properly assessed and punished", while also rejecting any suggestion say e don play im last match for Portugal.
"We go get one or more farewell matches, time still dey for that," the statement talk.
Manager Jesus tok on Sunday saydi door still dey openfor Ronaldo to return if e choose to do so, but many pipo believe say di damage don already happun.
Portuguese football journalist Delgado tell BBC Radio 5 Live: "I no tink say any way back dey. For the statement, Ronaldo tlk say e go return to di national team but at di same time e call Jesus liar three times.
"For di opinion polls wey dem conduct for Portugal about dis wahala, only 15% of Portuguese pipo support Ronaldo and pipo believe say we owe am plenty, but im time don pass and e need to understand dat.
"Di problem be say Ronaldo no understand am. E still want kontinu to play like person wey be 24 years old instead of 41.
"Tins no go ever remain di same again. No matter wetin happun, weda e play again or dem organise farewell match for am, tins no go ever remain di same again.
"Wetin Ronaldo do for Portuguese football na sometin unique and incredible and we gatz to tank am for all the service wey e give Portugal. But at 41, e no get place for Portugal best XI."
Reports tok say manager Jesus say e never see Ronaldo statement bicos e dey watch Portugal Under-21 match.
Al-Nassr forward Ronaldo don score 146 goals in 234 appearances for Portugal, both of dem na world records, and e help dem win Euro 2016 and di Nations League two times.
E no look say Ronaldo go retire from di national team bifor e reach di 1,000-goal mark wey e dey chase for club and kontri, as e currently get 980 goals.
But don im actions make di situation impossible to manage?
Wen e come to fans, opinion appear divided.
For several billboards around Lisbon, pipo put posters dey praise Ronaldo and criticising Jesus.
Di posters read for Portuguese: "Tank you Cristiano Ronaldo for evritin wey you do for Portugal. You go always remain our captain.
"Jorge Jesus no fit handle di job. E no show enough understanding. E treat di captain wrongly. Too much ego."
For di Denmark game, some fans wear T-shirts wey spell out 'Love you Jesus' while odas wear Ronaldo merchandise from head to toe.
Wetin dey next for Messi?
Unlike Ronaldo situation,Messi draw curtain on im glorious Argentina careerin front of 85,000 fans wey fill di Monumental Stadium for Buenos Aires.
Di 39-year-oldannounce im retirement from international footballfor August afta Argentina finish as runners-up for di World Cup and following di death of im papa, Jorge.
Messi mark im final appearance for La Albiceleste wit one goal bifor e address di excited fans in one speech wey last almost 10 minutes.
Some of im teammates begin cry as Messi admit say e no want leave di pitch.
"Plenty emotions dey pass through me right now," e tok. "I dey sure say I don forget many tins wey I for like tok bicos dis na very difficult moment for me. Di first person wey come my mind na my papa.
"I dey leave grateful, proud and wit peace of mind. Tank una for evritin."
E write forsocial media on Wednesday, Messi add: "Yesterday na my last match and I don already begin miss di sky blue and white jersey.
"I know say I dey take di right decision. Na incredible journey wey full of joy and some sadness, but I know for sure say evri step wey I take worth am."
Messi also tank im family, teammates and clubs, and pay tribute to anoda Argentina legend, di late Diego Maradona.
Im Instagram post later receive response from Ronaldo, wey write: "Leo, afta many years of defending your kontri, you don create history wey go last forever.
"I get di highest respect for wetin you achieve wit Argentina. One hug."
Messi leave as di player wey don play di highest number of matches and score di highest number of goals for Argentina, but e go kontinu im club career wit Major League Soccer (MLS) side Inter Miami.
E look like say di eight-time Ballon d'Or winner wan enter di world of football club ownership and e don already begin make moves toward am.
E already own two clubs, Spanish fifth-tier side UE Cornella and second-tier CD Eldense, and e also be partner for restaurant chain El Club de la Milanesa, wey plan to open five branches for Catalonia.
Messi also get lifetime deal wit Adidas and one collection wit drinkware brand Stanley, while e dey invest for property and hotel businesses too.
Football expert Guillem Balague tok: "Coach Lionel Scaloni still insist say if Messi eva wan kontinu, e fit do am, and shame no dey for changing your mind. But dat chapter look like say e don close.
"If you ask pipo wey dey around am wetin dey next, dem go smile bicos Messi never really plan beyond im next match.
"Even so, shape of wetin dey ahead don already clear. E go remain inside football bicos e go find am difficult to live witout am, but im oda business interests spread far beyond di game."